Tuesday, 28 June 2011

Wise Baba Sege Advise

Baba Sege say economic growth, wen job no dey for African Countries don lead to frustration among youths in the past.
im talk am yesterday for the ongoing European Policy summit for Belgium, im talk say most of the katakata wey we de witness for Africa na because of work wey no de for we young people dem.


"one of the reason wey make youths dey stand up make dem over throw dem Leaders na because of work wey no dey for dem to do"

according to am "employment na de right of anybody wey wan work.
so in essence wetin im de yan be say make dem no open more schools until dem create work wey go fit carry all dem we corpers and graduate dem.
aw u c am?

No comments:

Post a Comment