One day one guy de on top im bike de go for road, na im cloud come down come rest on top im head, so God come tell am say
"Bamidele you don serve me well well sote i don decide say i go bless you with one request, so wetin be your request?" na im Bami come say "tuh God you know say all of us for Naija wan go abroad so God just do bridge wey go from naija hia go abroad for us abeg."
Na im God come say "Bami dis your request heavy o, because check out the amount of resources wey i go use do this the sand, the amount of stones and gravel with cement wey go reach under water, haba you sef check am na, no be say i no fit do am but your request too de materialistic so since i no fit justify am i go advice say you make another request, infact take todat off so that you go think am through"
so bami come think the tin well well, the next day na im e come tell God say "i don always de wonder how women dey tink, wetin dey make she dey shun me wen she dey vex, wetin make she luv me, wetin i fit do to please am, infact i just wan know wetin women want and make i de able to satisfy her every need."
Na im God come say dat your bridge ba na aw many lanes you want on top 3 abi 4.
No comments:
Post a Comment