Monday, 27 June 2011

Abeg remind me

Two elderly couple wey old age don dey catch up with, decide say dem go start one class wey de help people wey get short term memory catch up with wetin dem don forget.
so like two weeks after dem don start the class na, na in their neighbour meet the husband one morning, come ask am say;
"Papa Nkechi wetin be the name of the place wey una de go do this una class sef?"
"oooh, ummmh chai wetin be name sef o, ok shey you know that flower wey dey smell nice wey oyinbo dey like give their babes sef?"
the neighbour come say "Rose ba?" 
papa Nkechi come say "ehnn na im be dat" then im come turn face im house wia im wife sidon, then come shout "Rose!!" abeg wetin the name of that place wey we they go take class from?

No comments:

Post a Comment