Baba Sege say economic growth, wen job no dey for African Countries don lead to frustration among youths in the past.
im talk am yesterday for the ongoing European Policy summit for Belgium, im talk say most of the katakata wey we de witness for Africa na because of work wey no de for we young people dem.
"one of the reason wey make youths dey stand up make dem over throw dem Leaders na because of work wey no dey for dem to do"
according to am "employment na de right of anybody wey wan work.
so in essence wetin im de yan be say make dem no open more schools until dem create work wey go fit carry all dem we corpers and graduate dem.
aw u c am?
Anything gossip, jokes, Music, entertainment, Funny Images, Animated GIF, Nigerian and All Around the World
Tuesday, 28 June 2011
Laff n Jamz
Souncity don partner with Basket make dem be im sponsor for the laf 'n' Jams event, so na soundcity go dey cover and air the event for am, since im agree to sign the contract with dem, dis contract wey dem sign on the 22nd of this month be like say go help boost the event for am.
Man unkind video out
Our Home boy 2baba, the Ambassador for Nafdac don release the Man Unkind video, way 2go man.
The Bridge
One day one guy de on top im bike de go for road, na im cloud come down come rest on top im head, so God come tell am say
"Bamidele you don serve me well well sote i don decide say i go bless you with one request, so wetin be your request?" na im Bami come say "tuh God you know say all of us for Naija wan go abroad so God just do bridge wey go from naija hia go abroad for us abeg."
Na im God come say "Bami dis your request heavy o, because check out the amount of resources wey i go use do this the sand, the amount of stones and gravel with cement wey go reach under water, haba you sef check am na, no be say i no fit do am but your request too de materialistic so since i no fit justify am i go advice say you make another request, infact take todat off so that you go think am through"
so bami come think the tin well well, the next day na im e come tell God say "i don always de wonder how women dey tink, wetin dey make she dey shun me wen she dey vex, wetin make she luv me, wetin i fit do to please am, infact i just wan know wetin women want and make i de able to satisfy her every need."
Na im God come say dat your bridge ba na aw many lanes you want on top 3 abi 4.
Monday, 27 June 2011
suicide bomber
i hear say them don know who the suicide bomber be o, im name na Muhammed Manga and guess what this guy sef na business man e be o, get five children before im decide say im no know the use of im life come carry dash devil. IMAGINE THAT!
Abeg remind me
Two elderly couple wey old age don dey catch up with, decide say dem go start one class wey de help people wey get short term memory catch up with wetin dem don forget.
so like two weeks after dem don start the class na, na in their neighbour meet the husband one morning, come ask am say;
"Papa Nkechi wetin be the name of the place wey una de go do this una class sef?"
"oooh, ummmh chai wetin be name sef o, ok shey you know that flower wey dey smell nice wey oyinbo dey like give their babes sef?"
the neighbour come say "Rose ba?"
papa Nkechi come say "ehnn na im be dat" then im come turn face im house wia im wife sidon, then come shout "Rose!!" abeg wetin the name of that place wey we they go take class from?
free Office Work
The boss waka come work early in the morning one day, come find im manager de kiss im secretary.
Im shout the manager, "Is this what I pay you for?"
The manager reply say: "No, sir, this 1 I de do free of charge."
Im shout the manager, "Is this what I pay you for?"
The manager reply say: "No, sir, this 1 I de do free of charge."